WAEC examination, Akpos was
asked to complete the following:
1. He who fights and run away?
Akpos: E don surrender be dat na, na
fear catch am
2. A rolling stone? Akpos: No fit just
dey roll, na person push am
.
3. He who lives in a glass house?
Akpors: Na rich politician e go be.
4. A stitch in time? Akpors: Dey
prevent further tear tear.
5. Birds of the same feather?
Akpors: Na the same mama born
them.
6. One good turn? Akpors: Na correct
power steering fit do am.
7. A bird in hand? Akpors: Wetin e
wan be again if no be barbeque. Dem
plenty
for chicken republic.
8. Half bread is better than?
Akpors: Puff puff, buns or garri
without sugar.
9. A journey of a thousand miles?
Akpors: Na d person wahala be dat
na, Why e no enter car or aeroplane
jeje?
10. He who laughs last?
Akpors: Get brain problem. Make dem
examine am, becos
na begining of madness be dat.
11. A patient dog?
Akpors: Na hunger go kill am.
12. All work and no play?
Akpors: Na bank job be dat bros.
13. Once beaten?
Akpors: Na revenge go follow be dat.
14. A fool at forty? Akpors: U never
see Naija own, our own
starts @ 50
Tell your friends about us and share if you like this post
Best Rib Cracking Jokes, News, Entertainment, Inspiration, Job Vacancy, Scholarships positions
No comments:
Post a Comment