Wednesday, 31 July 2013

Akpos- Listen to my story

AKPORS receive beating bcos he won enter prison

here is my story

No be my fault.

Na wetin happen be this...

Me sef been dey reason the formation to enter power, I come see say:

Nelson Mandela from prison to president.

Obasanjo from prison to president.

Theodore Orji from prison to Gov.

Omisore Iyiola from prison to senator.

Al mustapha from prison to Brigadier General.

Na hin I come go front of barrack go slap soja man make a fit go prison.

Kai... my people, where una wan make a see hand and eye type joke.

The kin beatin wey I chop ma people, if a contest for Councillor, I no go win.

Ma eye don dey clear small small sha..

No comments:

Facebook Blogger Plugin: By RNHckr.com

Post a Comment

Blog Widget by LinkWithin

Copyright © 2013. All Rights Reserved :Asf Comedy Unit